BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
How President Tinubu UK State Visit wit di British Royal Family go waka
Di British Royal Family roll out di schedule of di flamboyant reception wey dem prepare for President Bola Tinubu and First Lady Remi Tinubu.
University student dey among two pipo wey die for Kent meningitis outbreak
BBC South East understand say 11 more pipo from di Canterbury area currently dey for hospital and report say dem dey seriously ill.
Serious flooding kpai 62 pipo for Kenya as heavy rains continue
Dem bin rescue 11 pipo overnight afta one minibus taxi stuck inside rising floodwaters for Nairobi.
Trump say US no ready to make deal with Iran, warn citizens to comot for 14 Middle East kontris
Though e refuse to say wetin dose terms be, Trump say Iranian commitment to abandon any nuclear ambitions go be part of a potential deal.
Which kontris fit profit from di US-Israel war wit Iran - and which ones go get di hardest hit?
Di US-Israel war wit Iran don already prove to dey costly for pipo around di world, as di looming energy and supply-chain crisis begin to bite - who dey most vulnerable and who fit actually come out ahead?
Shia members march in support of Palestine, Iran supreme leader to mark Quds Day for Nigeria
Some members of di Nigerian Shia community hold procession for di entrance of di National Mosque for Abuja, di kontri capital.
Nigeria opposition party ADC don gain more ground wit recent defections?
Dis defection of nine senators to di ADC don make am di leading opposition party for Nigeria ahead of di 2027 general elections.
Trump drop update about Iran Supreme Leader as US military plane crash kill all six crew members for Iraq
Di US Central Command say "di incident happun for friendly airspace during Operation Epic Fury", but no be hostile or friendly fire cause am.
Ginger Me
Special Tori
Police begin investigation afta Igbinedion Education Centre expel students inside viral video for bullying fellow student
One video wey go viral on Friday 13 March, 2026 show as one student dey use belt dey flog anoda student.
Dem comot Igbo from one textbook on Nigerian history?
Social media speculation about di contents of a textbook grow into a wider conversation about representation for Nigeria classrooms
Lagos investigate death of Nigerian socialite Elena Nkwopara wey die afta BBL surgery
Lagos State govment don begin full investigation into di death of one Nigerian socialite, Nkwopara Elena Jessica wey pipo sabi as "Elena"
Senegal approve 10 years in prison for pipo wey dey practice same sex
Di law make provision for prosecution and sanctions for all individuals and organizations wey dey promote LGBT ideology.
KLM cancel flights to Dubai till 28 March as US-Israel war wit Iran continue - Wetin oda airlines tok
Thousands of flights to and from di Middle East dey face serious disruption since late February, following Iranian strikes across di region in retaliation to US and Israeli bombardment.
'Cut off one head and new ones go grow back' - how Iran rulers build a system wey go hard to comot
Iran "hydra-like structure" don allow dem to withstand repeated shocks and e dey to easily comot dem, experts say.
How Ghana immigration arrest 93 Nigerians ova alleged internet fraud and oda crimes
Ghana authorities don arrest ova 90 Nigerians wey allegedly dey involved for internet fraud and oda crimes. Dem also repatriate 72 victims wey dis suspects bin allegedly capture and dey use for dia activities.
Trump hint on end to Iran war as Putin, China react to Mojtaba appointment as supreme leader of Iran
United States President Donald Trump don dey tok different-different tins bout di war wit Iran as di kasala don reach Day 10.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































